Wetin Bill Do Melinda?(Nigerian Pidgin English Poem)

4 views
Skip to first unread message

Chidi Anthony Opara, FIIM

unread,
May 4, 2021, 6:24:12 PM5/4/21
to USA African Dialogue Series
By Chidi Anthony Opara

Wetin Bill do Melinda
Wey make Melinda
Wan waka comot 
For di gate of Dem marriage?

Bill dey beat am?
Bill no dey give am chop money?
Abi Bill get side chick?
Wetin?

Wetin Bill do Melinda
Wey make Melinda
Wan waka comot
For di gate of dem marriage?
Wetin?

Bill still dey wella,
Strength dey,
Money dey,
Love dey,
Name dey,
Every every dey.

Wetin Bill do Melinda
Wey make Melinda
Wan waka comot
For di gate of dem marriage?
Wetin? 

(Nigerian Pidgin English Poem presented as social service, all rights reserved)
Reply all
Reply to author
Forward
0 new messages