This is the lyric of Big Blind Country by Fela
Anikulapo Kuti. For those who visited the shrine at Ikeja in the late 80s, this
was the shrine's Anthem which unfortunately was never released publicly before
his death but it is relevant to our current situation at local and national
level even ethnic level of all shades and colors in Naija. I heard the song and
had to write it out. Another is ALHAJI ALHAJI which will be posted on another
day.
Enjoy
BIG BLIND COUNTRY
Oh, Oh Everybody say ye ye oya oh
Let's go, you go dey answer "Esin don don", Now you
go dey answer for me oh
oh ya, "Kutu pa, Kutu pa"
chorus: "Esin don don"
Me I think say for this country dem cover our eyes
with cloth but now I think say na blind we blind not be cloth
cover,
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
In the country of the blind, na one-eye man be king
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
Na oyinbo talk say,
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
Na one-eye man be king
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
If everybody no get dem eye
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
How dem go fit see dem king?
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
If the king not get im eye?
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
How the rest of the country go know
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
King blind, everybody blind
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
Na permanent darkness be dat
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
If king go hire im eye
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
How the rest of the country go know
Chorus: In the country of the blind, na one-eye man
be king,
I don go put medicine for eye, no be oyinbo
medicine I put, na babalowo medicine I put,
my eye do open well well,
Since I dey use Oyinbo medicine, ma body never
better, I put for my y--sh, my y--sh still dey lick water,
I take belle medicine, my belle still swell up, I
put am for my eyes, I still never get my eye, .
I don put medicine for eyes, na babalawo medicine I
put, Oyinbo man talk, Oyinbo man shock,
chorus: Oyinbo man go jam
Demneverquine
chorus: Oyinbo man go jam
Demnicodeine
chorus: Oyinbo man go jam
Teramycin
chorus: Oyinbo man go jam
I want APC
chorus: Oyinbo man go jam
Paracetamol
chorus: Oyinbo man go jam
Demcatemol
chorus: Oyinbo man go jam
Teracatemol
chorus: Oyinbo man go jam
I want em Cafernol
chorus: Oyinbo man go jam
The Megezine
chorus: Oyinbo man go jam
The Megegine
chorus: Oyinbo man go jam
Anacin
chorus: Oyinbo man go jam
Give me Aspirin
chorus: Oyinbo man go jam
(continues with bastardization of different
pharmacological entities)
Ah aha aha in this state of Nigeria,
Na oyinbo language we speak, the government style
be say oyinbo things must better pass,
as my eye don open so, I don see everything, the
king wey dey our country, na hire im eye im eye,
That is the reason we dey think one king get one
eye, na oyinbo eye im go rent, na hire im hire im eye,
I don put medicine for eye, na babalawo medicine I
put,
All of us must get medicine, traditional medicine
for eye to comot for this
chorus: Kuru kere kuru kere
If you want to know
chorus: Kuru kere kuru kere
kuru kere meaning
chorus: Kuru kere kuru kere
when you dey waka slow
chorus: Kuru kere kuru kere
And then take style waka
chorus: Kuru kere kuru kere
oh, ye paripa
Chorus: Wetin you see
You know those people
Chorus: Wetin you see
those people dem dey call lawyers
Chorus: Wetin you see
See the thing wey dem all knack for
head
Chorus: Wetin you see
orisi risi oyinbo wig oh
Chorus: Wetin you see
The man wey dem say go steal for
market
Chorus: Wetin you see
Im go stand for court start to dey
look
Chorus: Wetin you see
The only thng wey im understand for
there
Chorus: Wetin you see
na when dem tell am to go for jail oh
Chorus: Wetin you see
I see plenty judges
Chorus: Wetin you see
dem dey parade inside dem wigs oh
Chorus: Wetin you see
That is a disgrace for this nation
Chorus: Wetin you see
For the thing dem bury themselves inside
oh
Chorus: Wetin you see
Awolowo
why all of dem they do like this?
Chorus: Wetin you see
Dem no dey for our own world oh
Chorus: Wetin you see
For dem to be proud of the ways of their
masters
Chorus: Wetin you see
Na oyinbo sense dem dey take jail us
oh
Chorus: tell us more, tell us more
Make I tell you more
Chorus: tell us more, tell us more
Wetin my eyes dey see
Chorus: tell us more, tell us more
African eyes dey see
Chorus: tell us more, tell us more
But you must go buy your own, African
medicine
Chorus: tell us more, tell us more
Original medicine
Chorus: tell us more, tell us more
So that you can see the correct thing
Chorus: tell us more, tell us more
With the correct eye
Chorus: tell us more, tell us more
oh oh Ye paripa
Chorus: Wetin you see
I see our fine women
Chorus: Wetin you see
Dem dey waka very fine oh
Chorus: Wetin you see
Traditional women dem dey waka
Chorus: Wetin you see
Educated women dem dey stroll oh
Chorus: Wetin you see
You see the educated women
Chorus: Wetin you see
All those wey dem don do for school oh
Chorus: Wetin you see
Na oyinbo hair dem dey knack
for head
Chorus: Wetin you see
Dem hair dey shine shine pass polish
oh
Chorus: Wetin you see
Dem get one wey dem call permy
Chorus: Wetin you see
The other one dem dey call jerry-curly
oh
Chorus: Wetin you see
Because dem dey for blind country
Chorus: Wetin you see
Dem dey spoil themselves with this style
oh
Chorus: Tell us more tell us more
Make I tell you more?
Chorus: Tell us more tell us more
wetin my eyes dey see
Chorus: Tell us more tell us more
African eyes dey see?
Chorus: Tell us more tell us more
I asked dem say
Chorus: Tell us more tell us more
As dem dey perm their hair, t-t- hair
nko?
Chorus: Tell us more tell us more
You go perm that one too?
Chorus: Tell us more tell us more
Dem tell me no.
Chorus: Tell us more tell us more
so, the hair of t-t-, is different from the hair of
head?
Chorus: Tell us more tell us more
Ah, na wa oh, may dem no go start to dey perm the
hair of t-t-
Chorus: Tell us more tell us more
Because na dat time, me sef I go hope
shop
Chorus: Tell us more tell us more
Oh oh, ye paripa
Chorus: Wetin you see?
Na the eye wey the king hire
Chorus: Wetin you see?
na im all of dem dey take see oh
Chorus: Wetin you see?
All of dem just dem make copy copy
Chorus: Wetin you see?
dem dey disgrace themselves everywhere
oh
Chorus: Wetin you see?
As far as me I dey
Chorus: Wetin you see?
Permy and Jerry curl no good oh
Chorus: Wetin you see?
Im just be like the tail of cows
Chorus: Wetin you see
na im all of dem dey knack for head oh
Chorus: Wetin you see?
We must all buy our African medicine
Chorus: Wetin you see?
To dey open our eyes very well oh
Chorus: Wetin you see?
To dey see everything correct
Chorus: Wetin you see?
Otherwise kuru kere will never stop
oh.
When yo dey waka
chorus: Kuru kere kuru kere
And you dey waka slow
chorus: Kuru kere kuru kere
Waka slow care
chorus: Kuru kere kuru kere
Then take style waka
chorus: Kuru kere kuru kere
Waka in darkness
chorus: Kuru kere kuru kere
(repeated all over again)
oh, ye paripa
Kuru kere kuru kere x 6
All the African leaders,
Na hire dem hire dem eyes,
Na oyinbo eyes dem rent,
That is the reason why corruption dey,
Authority stealing dey,
Kuru kere, Kuru kere kuru kere
Everybody make una
shout Ole for them, Ole
All our African leaders,
Na hire dem hire dem eyes,
Na oyinbo hire dem rent,
That is the reason why corruption dey,
Authority stealing dey,
Kuru kere, Kuru kere kuru kere
chorus x 3:
Corruption dey,
Authority stealing dey,
Kuru kere, Kuru kere kuru
kere
Segun