My Oh My!!,
Irene, na where you dey since? Of all di chicks wey dey parade my
Emperordom since I conquer am, na only you don return since gagul abi
na google come take over from deja. How your four children dey sef?
And how about dat your loud mouht boyfriend, Ken Onwere wey dey sell
guguru and epa for Ariaria market for Bakassi land? I hope una all dey
well? You still fine O!, but e be like say dem no dey give you food
well well for dat Zimbabwe. If weader too hard for dere, yyou fit land
for Waffi any time. We fit go for waterside catch plenty plenty fish
any time take make better pepper soup. You fit even bring Ken Onwere
come whit your four children. Before you comot from dis Waffi, make I
promise you someting - dat Kwashiokor/aneroxia nervosa body wey you
get go just disappear TwoFour. But make we leave di invitation until
man pikin return from Edmonton. Make you dey well you hear. I still
like you O! :-)
http://www.akwaibomstate.com/prosper.com
Don Tempest Propero, Di Grand Master (asking where all di cheri of my
Emperordom dey sef?) Who no know go know
ir...@mannequinat.com (Irene Malin) wrote in message news:<1d7da0f3.01080...@posting.google.com>...