By Chidi Anthony Opara
We dey inside moto park for Naija
Dey mussle our way,
Dey hussle,
Dey para,
Dey pussle
Di way our politician dem
Dey take us play ping pong.
After hussle,
We go go chill,
We go go shake bodi,
We go go shayo.
Wetin bi dis one
Wey bi say
We no go hear something again?
Everywhere now
Na Pennsylvania bi di talk.
Everywhere now
Na Trump talk say for Pennsylvania,
Na Kamala talk say for Pennsylvania,
Na wetin!?
Pennsylvania dey for America,
Here na Naija,
Wetin concern us for Pennsylvania?
We no dey live for America,
We dey live for Naija.
Make our government give us
Wetin we go take survive for Naija,
Wetin concern us for Pennsylvania?
Nothing concern us for Pennsylvania.
(Poem presented as social service, all rights reserved)
--
Chidi Anthony Opara is a Poet, Institute Of Information Management Professional Fellow, MIT Chief Data Officer Ambassador and Editorial Adviser at News Updates(
https://updatesonnews.substack.com)
He is a recipient of International Award/Recognition For Excellence In Data And Information Management, with 253 mentions on Academia(academia.edu)as at July 22nd, 2024.
More about him here: https://independent.academia.edu/ChidiAnthonyOpara